![]() You be the queen of my heart, na you dey on the throne.Na when I see your face, I been dey forget my sorrow.I no know say love fit sweet like dis.No be only your face wey dey burst my brain, your character be like gold wey don pass thru fire.I no fit lie you, I miss una too much.Your smile be like cold water wey dem pour for fire, na im dey melt my heart.I no fit explain how this love dey do me.I no fit lie you, the power of your love dey dabaru my head.I wan spend for your mata because say beta soup na money kill am.Your mama born pikin, na pesin you be. ![]() Omo any pesin wey get you for im life, e own don better.I be rich guy because una dey for my life Na because I get you, I dey feel like Dangote.I wish say you fit enter my heart dey see hoiw dis love they shack my head.Na you I wan take be the male’ to my children, I wan mey I spend the rest of my life with una. ![]()
0 Comments
Leave a Reply. |
Details
AuthorWrite something about yourself. No need to be fancy, just an overview. ArchivesCategories |